Obi Cubana EFCC: Obinna Iyiegbu wife Ebele, Cubana Chief Priest react to EFCC case

Obi Cubana wife Ebele Iyiegbu don react to im invite by Economic and Financial Crimes Commission [EFCC].

Na on Monday di businessman Obinna Iyiegbu, wey pipo sabi as Obi Cubana go EFCC – -Nigeria Economic Police – office by imsef.

One source from di EFCC tell, BBC Pidgin say dem no arrest Obi Cubana as tori pipo bin report.

And since wen Obi Cubana EFCC mata land, pipo don comot to react to di news.

For one Instagram post Obi Cubana wife say “I call am Nwachinemelu! Okpataozueora worldwide ❤️

“One man wit heart of Diamond.”

“We love you and we dey solidly behind you. Even Jesus don go through worse than dis so no stress.”

Ebele Iyiegbu add say: “Di grace dey overwhelming and e dey overflowing. God imself na im raise you.”

Again, I repeat…”Who God don bless, no man fit curse” because im go turn everything around for good.”

She add am say even if na na di good, di bad and di ugly, God go turn everytin around for am.

Cubana Chiefpriest wey be Obi Cubana business manager don also chook mouth for di mata, im say “Wetin no kill us dey make us stronger”, im add #freeCubana.

Singer Davido also post Obi Cubana picture for im Instagram story for wetin be like support.

Davido caption di picture “Obi Nwere ego”- wey mean Obi wit di money

Meanwhile, EFCC say “We no arrest Obi Cubana.”

“We don bin invite am come our office two weeks ago and e show up just yesterday around 11: AM by imsef for our office wey dey Wuse Zone 6 Abuja,” di source tok.”

Di 46-year old business man, Obi Cubana na from Anambra state for eastern Nigeria and e dey into entertainment and hospitality business.

Wetin Make EFCC invite Obi Cubana?

Di source inside EFCC say dem dey investigate Obi Cubana for Evasion of Tax by di Cubana group.

Oda charges wey dem dey torchlight di business man for na; Money Laundering and Abuse of di Naira in public places.

E no dey clear if di abuse of di naira charges dey related to di spraying of money wey happun during di burial of di mama of Obi Cubana for July dis year.

Di burial ceremony of Obi Cubana mama wey take place for im home town Oba, Anambra State bin make headlines and cause serious tok-tok for Nigeria social media platform.

During dat period, some Nigerians come begin tok about di money spraying by guest for di event but Obi Cubana defend am by saying na di guest get dia money and so dem fit spend am anyway dem like.

“How I go plan make pipo troway money, carry am bath? Di money na dem get am… na dem get dia money na dem get dia style,” Obi Cubana tell BBC Pidgin during one interview for July.

“Those pipo no be pipo wey I fit tell ‘do dis or do dis’… but I feel say na love dem wan come show.”.